Psalm Chapter 80

Abeg share
  1. Oh sheapard of Israel, hear us, you wey lead Joseph as shepherd dey lead
    sheep; you wey sidon dey shne for throne di middle of two cherubim,
  2. you dey shine for front of Ephraim, Benjamine and Manasseh. Make your big
    power wake up con save us.
  3. Chai Baba-God, build us again, make your face shine for awa body so dat we go
    save.
  4. Chai Lord God almighty, how long your vex go dey burn di prayers of your pipo?
  5. You don use bread of tear take feed dem, you don make dem drink tears wey
    full inside bowl.
  6. You don make awa neighbours dey fight us, awa enemies dey yab us.
  7. Build us again, chai Baba-God almighty; make your face shine for awa body so
    dat we go save.
  8. You bring vine comot from Egypt; and you drive di nations comot, and you con
    plant am.
  9. You clear di land for am, e get root, con grow and e con full di land.
  10. Di mountains con cover wit shades and di elele cedar wit hin branches.
  11. Hin branch long reach di seas and hin body go reach di River.
  12. Why you scata e walls so dat pipo wey dey pass dey pick hin grapes?
  13. Boars from forest dey chop am anyhow and di animals wey dey for field dey
    chop am.
  14. Come meet us again, Oh God almighty. Look down from heaven make you
    see! Dey watch dis vine,
  15. di root wey your right hand don plant, di son wey you don train for yourself.
  16. Your vine down cut for ground, con burn am wit faya; your pipo dey pkeme
    wen you change am for dem.
  17. Make your hand dey on di man wey dey for your right hand, man pikin wey
    you don train for yourself.
  18. So we no go fashi you; ginger us, and we go call your name.
  19. Build us again, Oh Lord God almighty; make your face shine for awa body so
    dat we go dey free.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *