- Di Lord dey reign, make di earth dey happy; make di water wey dey far-far dey
rejoice.
- Cloud plus heavy darkness dey around am; righteousness plus justice na di
foundation of hin throne.
- Faya dey burn for hin front wey dey lick hin enemies wey dey all hin side.
- Na hin lightening dey light up di world; di earth see am con fear-fear.
- Di mountains dey melt like candle water for Baba-God front, for front of di Oga
pkata-pkata of all di earth.
- Di heavens dey yarn about hin righeousness and all di pipo dey see hin levels.
- Shame don dey catch all di pipo wey dey worship image—those wey dey make-
mouth wit dia idols—make una worship am all di gods!
- Zion hear dey rejoice plus di villages wey dey Judah dey happy becos of your
judgement, Oh Baba-God.
- Na you, Oh Baba-God, be di Most High for di whole earth; you get levels pass all
di gods.
- Make all those pipo wey love Baba-God hate evil, he dey guard di lives of hin
faithful pikin, con comot dem from wicked pipo hand.
- Light dey shine for righteous pipo head and joy dey for di head of pipo wey get
clean heart.
- Rejoice for Baba-God, all of una wey dey righteous and praise hin holy name.
Post Views: 62