Psalm Chapter 98

Abeg share
  1. Sing new song for Baba-God, he don do elele tins; hin right hand and hin holy
    hand don work salvation for am.
  2. Baba-God don make pipo know hin salvation and he don show di nations hin
    righteousness.
  3. He don remember hin love and faithfulness for di house of Israel; all di end of di
    world don see di salvation of awa God.
  4. Shout wit joy to Baba-God all di earth, start to dey freestyle and jirate wit beta
    jamz;
  5. use di harp play music for Baba-God, wit harp plus beta voice,
  6. wit trumpet and sound of ram horn—shout wit joy for front of Baba-God di
    Oba.
  7. Make di seas make noise plus everitin wey dey inside am, di world, and everi-
    pesin wey dey stay there.
  8. Make di rivers clap dia hands, make di mountain sing together wit joy;
  9. make dem sing for Baba-God front, he dey come to judge di earth. He go judge
    di world wit righteousness and di pipo wit hin church-mind.

Questions about Psalm 98

What is Psalm 98 in Pidgin Bible?

This page contains Psalm 98 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-98/

Where can I read Psalm 98 in Nigerian Pidgin?

You can read Psalm 98 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-98/

Which Bible book contains Psalm 98?

Psalm is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Psalm 98?

The chapter identified by this reference is 98.

Topics connected to this passage

  • Love
  • Salvation
  • Worship

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now