Psalm Chapter 99

Abeg share
  1. Baba-God dey reign, make di nations dey shake; he sidon for throne for middle
    of cherubim, make di earth shake.
  2. Baba-God na ogbonge for Zion; he get levels pass all di nations.
  3. Make dem praise you ogobge and elele name—he dey holy.
  4. Di king dey mighty and he love justice—you don stand your justice gidigbam;
    for Jacob, you don do wetin dey fair and right.
  5. Make una cut-cap for Baba-God wey be awa Oga and make una worship for hin
    footstool; he dey holy.
  6. Moses and Aaron dey among hin priest, Samuel dey among those pipo wey call
    hin name; dem call Baba-God and he ansa dem.
  7. He follow dem tok from di pillar of cloud; dem keep hin law and di
    commandment wey he give dem.
  8. Oh Baba-God wey be awa Oga, you ansa dem, you be God wey dey forgive
    Israel, even though you punish dem for di bad tins wey dem do.
  9. Make una cut-cap for Baba-God wey be awa Oga, con worhip for hin holy
    mountain, Baba-God wey be awa Oga dey holy.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *