Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 29

Abeg click here to share dis post

Baba-God Voice

  1. Dis na Psalm of David. Give to Baba-God oh sons of di great ones, give Baba-God levels plus strength.
  2. Cut-cap for Baba-God for di levels wey fit hin name; worship Baba-God inside di beauty of hin holiness.
  3. Baba-God voice dey on top of water; di God wey get levels dey halla like thunder, Baba-God dey halla like thunder on top di big-big-river.
  4. Baba-God voice get pawa, Baba-God
    voice be like King voice.
  5. Baba-God voice dey break strong wood; Baba-God go break di cedar of Lebanon into pieces.
  6. He go make dem skip like malu- pikin,
    Lebanon plus Sirion like young bush ox.
  7. Baba-God voice dey make lightning
    flash.
  8. Baba-God voice dey shake di desert;
    Baba-God dey shake di desert of Kadesh.
  9. Baba-God voice dey make deer born
    pikin. Hin voice dey clear forest; and everi-pesin inside hin worship-place go shout, “Glory!”
  10. Baba-God sidon for king-chair—on top
    of di plenty-water; and Baba-God dey for king-chair as King forever.
  11. Baba-God go give hin pipo pawa; Baba-God go bless hin pipo wit peace.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website