Psalm Chapter 71
Di Prayer Of Senior-man
- Oh Baba-God, na you I dey trust; make
shame no ever catch me. - Save me inside your goodness, and epp me escape. Hear me, and free me.
- Be my rock wey I dey always hide my
head put, you don give your word to save me, na you be my rock and strong-house. - Free me, Oh my God—from wicked
pipo hand, and from evil men, plus wicked men. - Oh Baba-God, na you be my hope, na
you I dey trust since wen I be youth. - Since dem born me, na you don keep me; you bring me come out from my mama belle. Na you I go always praise.
- Many pipo dey wonder becos of me, but na you be my strong- house.
- Make my mouth burku wit your praise,
and wit your glory—from morning till night. - No fashi me wen I don old; no leave
me—wen I no-get-pawa again. - My enemies dey bad-mouth me; and
pipo wey dey wait to take my life dey plan togeda. - Dem tok sey, “Baba-God don komot
from hin side; pursue am make we catch am; no-pesin fit save am.” - Oh Baba-God, no dey far from me;
sharp-sharp come epp me! - Make di enemies of my life confuse, and make dem kpeme; make shame plus disgrace catch all those pipo wey wan wound me.
- But as for me, I go kontinu to hope, I go always praise you more- more.
- My mouth go tok about your
goodness—from morning till night, becos I no-fit count dem finish. - I go move wit di pawa of Baba-God, I go tok only about your goodness.
- Oh Baba-God, since wen I be small
pikin, na you don dey teach me, and reach today—I go tok about your ogbonge works. - Even wen I don old wit white hair for my head—no fashi me, oh Baba-God; until I show your strength to di next generation, and your pawa to pikin wey dem neva born.
- Your goodness high well- well, oh Baba-God—you wey don do big-big tins. Who be like you, oh Baba-God?
- You wey don make me see plenty and serious wahala—go ginger me again, and you go raise me up again from under ground.
- You go add-join my greatness, con cool me down from everi side.
- Becos of your faithfulness, I go praise you wit lute, oh my God; I go sing praises to you wit harp, oh Holy One of Israel.
- My lips go sing wit serious happiness wen I sing for you—plus my soul wey you don save.
- My tongue sef go tok about your correct works— f rom morning till night, shame and katakata don meet those pipo wey wan wound me.