Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 122

Abeg click here to share dis post

Jerusalem

  1. Dis na song of rising. I happy wen dem tell me sey, “Make we go Baba-God house.”
  2. Awa leg don dey stand inside your gates, oh Jerusalem.
  3. Dem build Jerusalem as city wey di pipo dey togeda.
  4. Na for there di tribes of Baba-God dey
    gada put, to praise Baba-God name based-on di law wey he give Israel.
  5. Na for there di king-chair of judgement stand put, di king-chairs of di house of David.
  6. Pray make peace dey for Jerusalem;
    “Make those pipo wey love you prosper.”
  7. Make peace dey inside your walls, and make prosperity dey for your palaces.”
  8. Becos of my pipo and padi, I go tok sey, “Make peace dey around you”
  9. Becos of di house of Baba-God awa Oga, I go hustle for you to prosper.”

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website