Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 123

Abeg click here to share dis post

Dis Na Prayer Of Mercy

  1. Dis na song of rising. Na your face my
    eyes dey look—you wey your king-chair dey for heaven.
  2. As workers take dey look dia oga face, as house-girl take dey look her madam face, naso awa eyes take dey look Baba-God awa Oga—until he sorry-for us.
  3. Sorry-for us, chai Baba-God, sorry-for
    us, becos we don endure as pipo hate us wella.
  4. Awa soul burku wit di insult of pipo wey dey buga—and pipo wey dey feel-big hate us well- well.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website