Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 125

Abeg click here to share dis post

Baba-God Surrounds Hin Pipo

  1. Dis na song of rising. Those pipo wey
    trust Baba-God be like di Mountain of Zion wey no-fit shake, but wey dey kamkpe forever.
  2. As mountain take round Jerusalem, naso Baba-God take round hin pipo—both now and forever.
  3. Di govment of wicked pipo no go dey for di land wey Baba-God don give good pipo, so dat good pipo go use dia hand take do evil tins.
  4. Baba-God, do good to those pipo wey
    dey good, to those pipo wey get clean-heart.
  5. But pipo wey turn follow kurukere way, Baba-God go pursue dem komot wit pipo wey do evil tins. Make peace dey for Israel.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website