Job Chapter 40
Job Sempe For Baba-God
- Naso Baba-God tell Job sey,
- “Abi you still wan argue wit Baba-God Almighty? You dey see fault inside Baba-God, but you get ansas?”
- Job con ansa Baba-God,
- “I be notin—how I go fit ever get ansa? I go cover my mouth wit my hand.
- I don already tok too much. I no get anytin to tok again.”
- Naso Baba-God ansa Job from inside di rolling-breeze:
- “Hold body like man, becos I get some questions to ask you and you must ansa dem.
- “Abi you go downgrade my justice, con condemn me just to confam sey you dey correct?
- Abi you strong reach Baba-God? Abi you fit shout like thunder like am?
- Ok, wear your levels and your beauty, your respect and your levels as king.
- Look di pipo wey dey feel-big; pour your vex on dem, and make you bring dem down.
- Look di pipo wey dey feel-big, and make you bring dem down; and march wicked pipo for where dem dey.
- Bury dem for inside dust togeda, cover dia faces for dark place (di house of death).
- Den even me go praise you, becos your own pawa go save you.
- “Just look Behemoth wey I make just as I make you; he dey chop grass like malu.
- See di pawa for hin belle, plus di muscles for hin belle.
- E tail dey stand up strong like cedar wood, di muscles for e lap tight togeda.
- E bones be like strong pieces of bronze; and e ribs be like thick iron.
- Na good example of Baba-God handwork, and na only Baba-God wey make am nahin fit threaten am wit sword.
- Di mountains dey feed am wit dia best food, where all di wild animals dey play.
- E dey lie down under di trees wit shade, and e dey hide under di grass of di swamp.
- Di trees wit shade dey give am shade among di willows near di stream.
- Di water wey dey vex no fit disturb am, and e no-send even wen river Jordan dey over-flow.
- No pesin fit catch am dey loose guard or put ring for e nose to carry am komot.