Job Chapter 41
Baba-God Pawa Inside Big Animal
- Abi you fit catch di biggest animal for big-big-river wit hook, or tie e tongue wit rope wey you put inside water?
- You fit tie e nose wit rope, or use hook take shuuk e jaw?
- Abi e go beg you well-well make you sorry-for am? Abi e go follow you tok soft words?
- Abi e go make agreement wit you, abi you go take am as servant forever?
- You fit play wit am like bird, or carry am give your small girls make dem use a take play?
- Abi market-pipo go try to buy am—to sell am for shops?
- Abi you go fit shuuk e skin wit long-sharp-weapon, or shuuk e head wit long-fish-arrow?
- If you put your hand on am, you go surely remember di fight wey go happun. For your life, you no go try am again!
- No, e no make sense for you to try to catch am. Di hunter wey try to catch am go fear wen he see am.
- And since no pesin get-liver to disturb am, who go con fit face me?
- Who don first give Me anytin—sote I need to pay a back? Everitin wey dey under heaven belong to me.
- “I wan tok more about di biggest animal for water, and e big pawa, plus di way e take fine.
- Who fit komot e skin, and who fit cut enta di double skin, or who fit near am wit two ropes to control am like horse?
- Who fit open e jaws? E teeth long and sharp well-well round e mouth!
- Di scales for e back be like plenty shields wey dem join togeda tight.
- Dem near demsef well-well sote no air fit pass tru dem.
- Everi single scale dey join di next one tight. Dem lock demsef and notin fit pass tru am.
- “Wen e sneeze, e dey flash light! E eyes be like di lines-of-light of di morning sun.
- Light wey dey burn dey komot from e mouth. Sparks of faya dey jump out!
- Smoke dey komot from e nose-pipe, like pot wey dey boil or grass wey dey burn.
- E breath go make charcoal catch faya, and faya dey komot from e mouth.
- Pawa dey for e neck, and fear dey dance for e front.
- E skin hard and strong kakaraka sote notin fit shuuk am
- E heart strong like stone, e strong like grinding-stone.
- Wen e stand up, strong men dey fear, dem dey kpanji wen e dey jump inside di water.
- No sword fit stop am, no long-sharp-weapon, sharp-stick, or long-arrow.
- To am; iron be like grass, and bronze be like wood wey don rotten.
- Arrows no fit make am run. Stones wey dem shoot from catapult be like chaff for am.
- Sticks be like grass for am, and e dey laff wen men dey throw long-sharp-weapons.
- E belle cover wit fish-skin wey sharp like pieces of clay pot wey don break. E dey dig di ground as e dey move for mud.
- E dey make di deep-deep water boil like pot: he dey make di water boil like pot of ororo.
- Wen e move, di water dey shine wit foam for hin back—like sey e get white hair.
- Notin for earth fit stand am, no oda animal dey wey no dey fear like am.
- Out of all di animals, nahin dey feel-big pass. Nahin be di king of all di animals wey dey feel-big.”