Psalm Chapter 8

Abeg share
  1. Oh Lord, awa Lord, see as your name dey majestic for the whole world! You
    don set your glory high pass heaven.
  2. From small-small pikin and babies lips nahin you don order praise becos of your
    enemies, to silence di enemies and di di pipo wey dey retaliate.
  3. Any time I tink of your heaven and your hand work, the moon and di stars, wey
    you don set for dia place,
  4. who be man for where you dey, who be man pikin wey you con dey reason hin
    mata.
  5. You make am get levels like angels small, you con put crown of glory plus honor
    for hin head.
  6. You make man rule of di works wey you don make; you put everitin under man
    leg:
  7. all animal family and animal community, and di wild animal big for bush,
  8. di bird wey dey fly for air plus fish wey dey for water, all animals wey dey swim
    for inside di sea.
  9. Oh Lord, awa Lord, see as you name dey majestic for di full earth!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *