Psalm Chapter 11

Abeg share
  1. Na inside Baba-God I dey hide my head. How you fit con tell me sey: ‘Fly like
    bird go your mountain.
  2. See, wicked dey arrange dia weapon, dem dey set dia bow and arrow for
    darkness to shoot Baba-God pikin for heart.
  3. If di foundation dey pkafuka, wetin Baba-God pikin go do?
  4. Baba-God dey inside hin holy temple; God dey for hin throne for heaven; He
    dey observe man pikin; hin eyes dey look inside dia mind.
  5. Baba-God dey observe di righteous pipo, but hin soul hate wicked pipo and
    those pipo wey like fight-fight.
  6. He go pour hot faya and burning sulfur for wicked pipo head; breeze wey go
    burn nahin go meet dem.
  7. Baba-God dey righteous, he like justice; men wey dey waka straight go see hin
    face.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *