Psalm Chapter 16

Abeg share
  1. Keep me safe Baba-God, na for inside your body I dey hide my head.
  2. I follow God yarn sey, ‘Na you be my Oga; I no get any oda good tin apart from
    you.’
  3. As for di holy-pipo wey dey di land, na dem be glorious pipo wey I dey happy
    for.
  4. Plenty bad tins go happun to dis pipo wey dey follow oda gods. I no go pour out
    dia libations of blood or call dia name wit my lips.
  5. Baba-God you don give me wetin I want for life, you don secure my land and di
    tins wey I get.
  6. My land dey for beta area.
  7. I go praise Baba-God wey dey advice me; even wen I dey sleep, my heart dey
    tell me wetin to do.
  8. I dey always put God for my first. Becos he dey for my right hand, I no get
    shaking.
  9. So my heart dey happy and my tongue dey sing; my body sef go rest wit no-lele,
  10. becos you no go fashi me to go grave, or you no go allow your holy pesin to
    rotten.
  11. You don show me di way of life; you go full my heart wit joy for your front,
    with jolly-jolly brekete forever—for your right hand.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *