- As deer take dey find water to drink, naso my heart dey fyne you Oh Baba-God.
- My soul dey fyne di living God like man wey wan drink water. Wen I go fit go
meet God?
- Na my tear I dey chop from morning to night as pipo dey tell me from morning
to night sey, “Where your God dey?”
- Na all dis tins I dey remember as I dey tok wetin dey for inside my mind; as I bin
dey follow plenty pipo, dey lead di movement of God-pipo enta Baba-God house,
as we dey shout wit joy and thanksgiving wit di pipo wey dey jirate.
- Why you put yourself for ground chai my soul? Why na so-so palava full inside
me? Put our hope for Baba-God, I go praise am, my savior and
- my God. My soul dey low key inside me; so I go remember you from di land of
Jordan, di height of Hermon—from mount Mizar.
- Deep dey halla deep as your waterfall dey shout, all you waves and brakers don
sweep me fall.
- Baba-God dey direct hin love for day time, for night hin song dey wit me—as
prayer to God wey get my life.
- I dey yarn my God wey be my rock sey, “Why you don fashi me? Why must I
dey cry upandan wen my enemies don use me do anyhow?
- My bones dey suffer pain wey fit kill am as my enemies dey wyne me dey tell
from me morning to night sey, “Where your God dey?”
- Why you put yourself for ground chai my soul? Why wahala full inside me?
Put your hope for Baba-God, I go still dey praise am, my saviour and my God.
Post Views: 52