Psalm Chapter 42
- As deer take dey find water to drink, naso my heart dey fyne you Oh Baba-God.
- My soul dey fyne di living God like man wey wan drink water. Wen I go fit go
meet God? - Na my tear I dey chop from morning to night as pipo dey tell me from morning
to night sey, “Where your God dey?” - Na all dis tins I dey remember as I dey tok wetin dey for inside my mind; as I bin
dey follow plenty pipo, dey lead di movement of God-pipo enta Baba-God house,
as we dey shout wit joy and thanksgiving wit di pipo wey dey jirate. - Why you put yourself for ground chai my soul? Why na so-so palava full inside
me? Put our hope for Baba-God, I go praise am, my savior and - my God. My soul dey low key inside me; so I go remember you from di land of
Jordan, di height of Hermon—from mount Mizar. - Deep dey halla deep as your waterfall dey shout, all you waves and brakers don
sweep me fall. - Baba-God dey direct hin love for day time, for night hin song dey wit me—as
prayer to God wey get my life. - I dey yarn my God wey be my rock sey, “Why you don fashi me? Why must I
dey cry upandan wen my enemies don use me do anyhow? - My bones dey suffer pain wey fit kill am as my enemies dey wyne me dey tell
from me morning to night sey, “Where your God dey?” - Why you put yourself for ground chai my soul? Why wahala full inside me?
Put your hope for Baba-God, I go still dey praise am, my saviour and my God.
Questions about Psalm 42
What is Psalm 42 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 42 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-42/
Where can I read Psalm 42 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 42 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-42/
Which Bible book contains Psalm 42?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 42?
The chapter identified by this reference is 42.
Topics connected to this passage
- Love
- Hope
- Worship