Psalm Chapter 41
- Blessed na di man wey dey reason pipo wey no get power; na Baba-God dey
save am wen kasala burst. - Baba-God go protect am and keep hin life; God go bless am for di land and
Baba-God no go let the bad tins wey badbelle pipo want make e happun to am,
happun to am. - Baba-God go keep am wen hin sick ontop bed, con make am stand up from hin
sickbed. - I sey, “Oh Baba-God, sorry for me; heal me, I don sin against you.”
- Wit badbelle, my enemies tell me sey, “Wen he go pkie and he name go
pkeme?” - He dey lie for my head any time pesin fyne me come, he dey lie for my head, as
hin heart dey gather bad tins wey he wan yarn about me; naso he go go out con
start to dey do tatafo. - All my enemies dey tok my mata small-small; dem dey imagine sey sometin bad
go happen to me. Dem sey,
8.“Evil disease don catch am; he no go fit ever stand up from di place wey hin dey
sleep.” - Even my padi wey I trust, wey I dey follow me chop don change am for me.
- But you, Oh Baba-God, sorry for me; carry me up so dat I do make pay for
wetin dem do. - I know sey you dey happy wit me, my enemies no go fit win me.
- You dey keep me inside my honesty.
- Prasie be to Baba-God, di God of Israel, from everlasting to everlasting. Amen
and Amen.
Questions about Psalm 41
What is Psalm 41 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 41 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-41/
Where can I read Psalm 41 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 41 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-41/
Which Bible book contains Psalm 41?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 41?
The chapter identified by this reference is 41.
Topics connected to this passage
- Faith
- Forgiveness
- Strength
- Healing