Psalm Chapter 45

Abeg share
  1. My heart dey move wit some beta punch-line as I dey read my poem for di king;
    my tongue na di biro of writer wey sabi write well-well.
  2. Na you be successful pass among men and God don anoint your lips wit grace,
    since Baba-God don bless you forever.
  3. Carry you sword for your side, Oh mighty one; baffup like king wey get levels.
  4. Carry-go front like king wey don win for truth, humbleness and righteousness;
    make your right hand show ogbonge work.
  5. Make your sharp arrow shuuk di heart of di King enemy, make di nations fall
    under your leg.
  6. Oh Baba-God your throne go last forever and ever; na staff of justice go be di
    staff of your kingdom.
  7. You love righteousness, con you hate wickedness; so Baba-God wey be una God
    go anointing una wit di ororo of joy to give una levels pass una padi dem.
  8. Perfume of myrrh and aloes plus cassia nahin dey scent fot all your cloth; from
    palace wey dem design wit ivory, muic from string dey make body dey sweet you.
  9. King daughters dey among your women wey dem respect; di royal bride wey
    baffup wit gold of Ophir dey for your right hand.
  10. Hear me, Oh daughters, calm dowm make you listen to me: Forget your pipo
    and your family dem.
  11. Your beauty don blow the king mind; respect am becos na your Oga.
  12. Di daughter of Tyre go carry gift come, men wey get power and moni go fyne
    your favor.
  13. Di princess get levels well-well for her yard; na gold dem take weave her
    gown.
  14. Na designer dress she go wear wen dem wan carry her go meet di king; her
    padi wey be virgn go follow her and dem go bring her come meet you.
  15. Naso dem go waka enta di palace wit joy and happiness.
  16. Your sons go take over from dia papa, you go make dem princes all over di
    land.
  17. I go make pipo remember you from generation to generation; so di nation go
    cut-cap you forever and ever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *