Psalm Chapter 46
- Na Baba-God we dey hide awa head put and nahin be awa strength, he always
dey to epp us wen yawa gas. - So fear no go catch us even if di earth dey shake and di mountain fall inside di
sea, - even though di water dey make noise and dey foam, and di mountain dey
shake anyhow as e dey burs-out. - One river dey wey di water dey make Baba-God city jolly, di high place where di
most high dey stay. - Baba-God dey stay around her, she no go fall, God go epp her before morning
reach. - Nations dey pkara, kingdoms dey fall; di earth dey melt wen he raise hin voice.
- God almighty dey wit us; na God of Jacob be awa strong-house.
- Make una come see Baba-God works, di dsuffer-head wey he don bring come
di earth. - He stop all di war wey dey di earth; he break all di bows con scata all di spear,
he use faya burn di shield. - “Make you relax and know sey na me be Baba-God; my level go high for
where di nations dey, my level go high for di earth.” - Baba-God almighty dey wit us. Na God of Jacob be awa strong-house.
Questions about Psalm 46
What is Psalm 46 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 46 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-46/
Where can I read Psalm 46 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 46 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-46/
Which Bible book contains Psalm 46?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 46?
The chapter identified by this reference is 46.
Topics connected to this passage
- Fear
- Strength