- Sorry for me, chai Baba-God wit your love wey no dey fail; comot my big-big
sins wit your serious kindness.
- Make you wash away all my bad-bad sins and clean me from my sins.
- I know sey my big-big sins, and di bad tins wey always dey around me.
- Na against you, na only you I don sin against and I don do evil for you front, so
dat I no fit tok for where you dey yarn, and make judgement dey correct wen you
judge.
- Even sef, I be sinner wen my mama born me, I get sin from wen my malee carry
my belle.
- True-true, you want make truth dey inside me, you teach me wisdom for
inside-inside your house.
- Clean me wit hyssop, and I go dey clean; wash me and I go white pass snow.
- Make I hear Joy and gladness; make my bones wey you don press for ground
rejoice.
- Carry you face comot from my sins and make you comot all my bad sins from
my mind.
- Make pure heart dey inside me, Oh Baba-god, and make you give me spirit
wey dey stand gidigbam.
- No purue me comot from you front or carry your holy spirit comot from my
body.
- Still give me di joy wey I feel wen your save me, and give me the spirit wey go
obey you, to fit keep me.
- So I go teach your way to pipo wey dey do bad-bad tins, and sinner go change
follow you.
- Save me from blood of men for my head, Oh God, di God wey dey save me,
and my my tongue go sing about your righteousness.
- O Lord, open my lips, and my mouth go yarn your praise.
- Sacrifice no dey make body sweet you, or I for bring am come; body no dey
sweet you for burnt offering offering.
- Di kain sacrifice wey Baba-God want wey dey low-key; Baba-God you no go
bone heart wey don break and heart wey ready to change.
- Make Zion prosper as body dey sweet you build di wall of Jerusalem.
- So righteous sacrifice go con dey, full burnt offering wey I go make body sweet
you; we go offer malu for your altar.
Post Views: 65