Psalm Chapter 53
- Mumu pipo don tok for dia heart sey, “Baba-God no dey.” Dem don currupt
finish and dia ways na evil; no-pesin dey do good. - Baba-God dey look man pikin from heaven for man pikin dem to see if any-
pesin dey wey understand and wey dey fyne Baba-God. - Everi-pesin don carry face comot, all of dem don spoil finish; pipo no dey do
beta tin. I no see one single pesin. - Shwoo, badbelle go ever learn—pipo wey dey chop my pikin as men dey chop
bread and wey no dey call God? - See as dem con dey, fear don kill dem finish, for where nothing bin dey
threaten dem. Baba-God don scata-scata all di bones of pipo wey dey attack you;
you make shame catch dem, Baba-God no like dem. - Oh, make salvation for Israel come out from inside Zion. Make body sweet
Jacob and make Israel dey happy wen Baba-God go give hin pipo back dia beta-
fine-fine tins.
Questions about Psalm 53
What is Psalm 53 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 53 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-53/
Where can I read Psalm 53 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 53 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-53/
Which Bible book contains Psalm 53?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 53?
The chapter identified by this reference is 53.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Fear