Psalm Chapter 61

Abeg share
  1. Hear my cry, chai Baba-God, listen to my prayer.
  2. From where di earth end nahin I dey cry to you, I dey call you as my heart don
    dey weak; carry me go di rock wey tall pass me.
  3. No you I dey hide my end put, you be like strong tall building against my
    enemies.
  4. I wan stay inside your caban forever con hide my head put for under your
    wings.
  5. You don hear my vow Baba-God, you don give me di beta-beta tins wey pipo
    wey dey fear your name surpose get.
  6. Add join di days of di king life, add joing hin years for many generations.
  7. Make hin sidon for throne for front of Baba-God forever; choose your love and
    faithfulness take protect am.
  8. Na then I go con sing praises to your name, con fufill my vow everyday.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *