Psalm Chapter 69
- Save me, Oh Baba-God, di water don reach my neck.
- Dey sink for inside swap, for where no strong ground for me to put my leg. I
don enta inside deep water, di plenty water wan carry me go. - I don taya to dey shout for epp; my throat don dry finish. My eyes dey don dey
close as I dey fyne my God. - Those pipo wey hate me without reason plenty pass di hair wey dey my head;
my enemies plenty for no reason, those pipo wey wan scata me. Dem don force
me pay for wetin I no thief. - You know my mumu-way Baba-God, you fit see di bad-bad tins wey I don do
wey dey disturb my mind. - Make disgrace no catch those pipo wey dey put dia hope on you becos of me,
Oh Oga, di Lord almighty; becos of me make shame no catch pipo wey dey fyne
you, Oh God of Israel. - I dey maintan as dem dey treat men anyhow becos you and shame don cover
my face. - I be JJC for front of my brodas, I be like foreigner for front of my own mama
pikin; - I get serious mind die—for your house, and di insult of those pipo wey dey
insult you dey fall on me. - Wen I cry and fast; I must endure as dem dey treat me anyhow;
11. - Those pipo wey dey sidon for front of di gate dey yab me, and na me
shayoman take dey sing. - But I dey pray to you, Oh Baba-God, ansa me wit your salvation wey sure, for
di time of your favor; and for inside your great love, Oh Baba-God. - Save me from di swamp, no let me sink, save me from those pipo wey hate
me, from water wey dey deep. - No let di flood water cover my head or let deep water carry me go, or let pit
swallow me. - Ansa me, Oh Baba-God, wit di goodness of your love, turn face me wit your
great mercy. - Make you no throway face from your servant; ansa me quick-quick, I dey
inside wahala. - Come near my side make you save me; save me becos of my enemies.
- You know as dem dey treat me anyhow, as shame and disgrace dey catch me;
all my enemies dey your front. - My heart don break becos dem don use me do any how and dem leave me wit
no epp; I fyne pesin wey fit even sorry for me, but I no see anybody, I fyne for
pesin wey go cool me down, but I no see any-pesin. - Dem put gall inside my food, con give me vinegar drink wen water dey hungry
me. - Make di table wey dem set for dem to chop turn to trap; make e turn to
punishment and trap. - Make dia eyes cover wit darkness so dat dem no go fit see, and make dia back
bend forever. - Pkara for dem; make your serious vex cover dem.
- Make everi-pesin run comot from where dem dey stay, make pesin no dey to
live inside dia house. - Pipo wey you wound nahin dem dey show pepper and dem dey do amebor for
pipo wey you whozz. - Put plenty crime for dia head; no allow dem share inside your salvation, Oh
Baba-God protect me. - Comot dia name from di book of life and make dia name no go dey wit
righteous pipo. - I dey inside pain and wahala, make your salvation, chai Baba-God, protect me.
- I go praise Baba-God name inside song con give am glory wit thanksgiving.
- E go make Baba-God belle sweet am pass Ox, pass nama wit horn and hoofs.
- Poor pipo go see am and hin belle go sweet dem—you wey dey fyne Baba-
God, make your heart live! - Baba-God dey hear pipo wey no get shi-shi and he no go fashi hin pipo wey
dem kidnap. - Make heaven and earth cut-cap for am, di water and everitin wey dey waka
inside am, - Baba-God go save Zion and he go build di city of Judah. Naso pipo go settle for
there con claim am; - Baba-God servant pikin go inherit am and pipo wey love Baba-God name go
stay for there.
Questions about Psalm 69
What is Psalm 69 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 69 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-69/
Where can I read Psalm 69 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 69 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-69/
Which Bible book contains Psalm 69?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 69?
The chapter identified by this reference is 69.
Topics connected to this passage
- Love
- Hope
- Prayer
- Salvation
- Strength
- Money
- Guidance
- Worship