Psalm Chapter 70
- Chai Baba-God, pkapkapka, make you save me; Oh Baba-God kiakia come epp
me. - Make shame and confusion catch those pipo wey wan kill me; make all those
pipo wey want make I fall turn back wit disgrace. - Make those pipo wey tell me sey, “Aha! Aha!” make dem turn back becos
shame don catch dem. - But make all those pipo wey dey fyne you rejoice and happy wit you; make
those pipo wey love your salvation always tok sey, “Make Baba-God level high!” - But I dey poor and no get shi-shi; sharp-sharp come meet me, Oh Baba-God. Na
you be my epp and na you dey free me; Oh Lord, make you no waste time.
Questions about Psalm 70
What is Psalm 70 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 70 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-70/
Where can I read Psalm 70 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 70 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-70/
Which Bible book contains Psalm 70?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 70?
The chapter identified by this reference is 70.
Topics connected to this passage
- Love
- Salvation
- Money