Psalm Chapter 79
Sadness On Top Jerusalem
- Dis na Psalm of Asaph. Chai Baba-God, di nations don take over your land; dem don dey spoil your holy worship-place, dem don scata Jerusalem for ground finish.
- Dem don carry your servants deadbody—give birds wey dey fly for sky, dem don carry di flesh of your holy-pipo— give wild animals of di earth.
- Dem don pour your servants blood like water, all around Jerusalem, wit no-pesin to
bury dem. - Awa neighbours dey yab us, those pipo wey dey around us dey use us play, and dem
dey laff us. - Oh Baba-God, how long you go dey vex forever? How long your jealousy go dey burn
like faya. - Para for di nations wey no gree know you, and for di Kingdoms wey no gree call your
name. - Dem don scata your pipo—Jacob, and dem don scata di place wey you dey stay.
- No use di sins wey we commit before before take judge us. Sorry-for us kiakia, becos we dey low-key.
- Epp us, Oh Baba-God awa Saviour, for di glory of your name. Free us, and forgive us
awa sins—becos of your name! - Why di nations go dey tok sey, ‘Where dia God dey sef?’ For front of awa eyes, show
yoursef among di nations-sey you dey revenge di blood of your servants wey dem
shed. - Baba-God, hear di cry of prisoners; use your big pawa take save pipo wey dem don sentence to death. Oh Baba-God, pay back seven times to awa neighbours, all di yab wey dem yab you.
- So dat we wey be your pipo, and di sheep of your green-land—go always tank you forever. And we go praise you from generation to generation
Questions about Psalm 79
What is Psalm 79 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 79 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-79/
Where can I read Psalm 79 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 79 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-79/
Which Bible book contains Psalm 79?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 79?
The chapter identified by this reference is 79.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Forgiveness
- Worship