Psalm Chapter 82
Oghene [Baba-God] Dey In Control
- Dis na Psalm of Asaph. Baba-God dey stand among di great ones, and he dey decide
among di gods. - How long una go dey judge wit ojoro, con show favour to wicked pipo?
- Defend pipo wey no get papa and mama; give justice to pipo wey dey inside palava,
and pipo wey need epp. - Save poor pipo, plus pipo wey need epp; free dem from wicked
- “Dem be olodo, dem no understand anytin. Dem dey waka upandan inside darkness; all
di foundations of di earth dey shake. - I tok sey ‘Una be gods,’ all of una be pikin of Baba-God Most High.
- But una go kpeme like men; una go fall like one of di princes.”
- Rise up, Oh Baba-God, judge di earth, all di nations belong to you
Questions about Psalm 82
What is Psalm 82 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 82 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-82/
Where can I read Psalm 82 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 82 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-82/
Which Bible book contains Psalm 82?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 82?
The chapter identified by this reference is 82.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Money