Psalm Chapter 83
Dis Na Prayer To Fall My Enemies
- Dis na song—na Psalm of Asaph. Oh Baba-God, make you no dey silent; no keep quiet, Oh Baba-God, no just dey like dat.
- See as your enemies dey ginger, see as pipo wey no like you dey carry dia head up.
- Dem dey plan wuru-wuru for your pipo; and dem dey plan bad tins against di pipo wey you dey protect.
- Dem tok sey, “Come make we scata dem, make dem no-fit form dia nation; so dat pipo
no go fit remember di name of Israel again.” - Dem plan togeda wit one mind; dem sign agreement to change am for you—
- di pipo of Edom, plus di Ishmaelites; Moab plus Hagrites,
- Gebal, Ammon and Amelek, Philistia wit di pipo of Tyre.
- Even Assyria don join dem: dem don epp Lot pikin.
- Do dem wetin you do to Midian, Siseria and Jabin for di river of Kishon,
- wey kpeme for En Dor, dem con be like yama-yama for ground.
- Make dia leaders be like Oreb and Zeeb, yes, all dia princes like Zebah and Zalmunna,
- wey tok sey, “Make we claim Baba-God land as awa own property.”
- Oh Baba-God, make dem be like dust inside breeze—like chaff for inside breeze!
- As faya take dey burn forest, and as faya dey burn for mountain,
- naso you go pursue dem wit your heavy breeze, and make dem fear wit your strong
breeze. - Oh Baba-God, use shame cover dia face so dat dem go fyne your name.
- Make shame and fear catch dem forever, make dem kpeme wit disgrace.
- Make dem know sey you—wey na only your name be Baba-God, and na you be Oga kpatakpata for di full earth.
Questions about Psalm 83
What is Psalm 83 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 83 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-83/
Where can I read Psalm 83 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 83 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-83/
Which Bible book contains Psalm 83?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 83?
The chapter identified by this reference is 83.
Topics connected to this passage
- Prayer
- Fear