Psalm Chapter 86

Abeg share

Dis Na Cry For Epp

  1. Dis na prayer of David. Oh Baba-God, bend your ear to hear me; becos I be poor pesin, and I need epp.
  2. Guard my life becos I be holy pesin; oh you be my God, save your servant wey trust you!
  3. Sorry-for me, chai Baba-God; I dey cry to you everi day.
  4. Put happiness for your servant life, Oh Baba-God, becos na you I dey carry my soul
    give.
  5. Baba-God, you dey good and you dey ready to forgive pesin, and you dey sorry-for
    pipo well- well—wey dey call your name.
  6. Hear my prayer, Oh Baba-God, hear my voice wey dey ask from you.
  7. I go call you for di day wen yawa gas, and you go ansa me.
  8. Among di gods, no one be like you Baba-God; no-pesin fit do di tins wey you don do.
  9. All di nations wey you don make—go come worship for your front, oh Baba-God,
    and dem go give your name levels.
  10. You too big, and you dey do ogbonge tins; na only you be Baba-God.
  11. Oh Baba-God, teach me your ways, and I go waka inside your truth; give me one mind, so dat I go fear your name.
  12. Oh Baba-God my Oga, I go praise you wit all my heart. I go give your name levels forever.
  13. You dey sorry-for me well- well. You don free me from grave.
  14. Oh Baba-God, pipo wey dey make-mouth dey fight me; and plenty wicked men dey fyne my life—men wey no dey reason you.
  15. But you, Oh Baba-God, you be God wey brekete wit kindness plus grace, you no dey quick vex, you dey sorry-for pesin well-well, and your truth brekete.
  16. Turn look my face, and make you sorry for me; give your pawa to your servant, and save me becos I dey serve you just like my mama serve you.
  17. Show me sign of your goodness, so dat shame go catch my enemies wen dem see am; becos you oh God, na you don epp me—con cool me down

Questions about Psalm 86

What is Psalm 86 in Pidgin Bible?

This page contains Psalm 86 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-86/

Where can I read Psalm 86 in Nigerian Pidgin?

You can read Psalm 86 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-86/

Which Bible book contains Psalm 86?

Psalm is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Psalm 86?

The chapter identified by this reference is 86.

Topics connected to this passage

  • Faith
  • Prayer
  • Salvation
  • Forgiveness
  • Fear
  • Money
  • Worship

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now