Psalm Chapter 92
- E good to praise Baba-God and compose music for your name, Oh Most High,
- to yarn about your love for morning and your faithfulness for night,
- to di music of di lyre wey get ten-string and di music of di harp.
- Your work dey make me happy, Oh Baba-God; I dey sing wit joy becos of your
handwork. - See as your work dey so great, Oh Baba-God. See as your reason big reach!
- Man wey no get sense no fit know, dondi no understand,
- sey even though badbelle grow like gras and wicked pipo dey shine, dem go
pkeme forever. - But you, Oh Baba-God, you get levels forever.
- Surely your enemies, Oh Baba-God, your enemies go surely pkeme ; pipo wey
dey do evil go scata. - You don give my horn levels like wild malu. Dem don pour beta ororo for my
head. - My eyes don see as my enemies take fall; my ears don hear about my wicked
enemies take pkeme. - Di righteous pipo go grow fine like palm tree, dem go grow like cedars of
Lebanon; - wey dem plant for inside Baba-God house, dem go flourish inside Baba-God
crib. - Dem go still produce fruit for old age, dem go dey fresh and green,
- dem go dey sey, “Baba-God way straight; nahin be my rock and wickedness no
dey inside am.”
Questions about Psalm 92
What is Psalm 92 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 92 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-92/
Where can I read Psalm 92 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 92 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-92/
Which Bible book contains Psalm 92?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 92?
The chapter identified by this reference is 92.
Topics connected to this passage
- Love
- Guidance
- Worship