Psalm Chapter 91

Abeg share
  1. Pesin wey stay for di crib of di Most High, go relax for the shadow of di
    almighty.
  2. I go yarn Baba-God sey, “Nahin I dey hide my head put and and nahin be my
    strong-house, my God wey I trust.”
  3. True-true he go save una from badbelle pipo trap and from virus.
  4. He go use hin feathers cover you, and you go hide your head for under hin
    wings. Hin faithfulness go be your gaurd and wall.
  5. You no go fear di gbege for night no di arrow wey dey fly for day,
  6. or di virus bad-bad disease wey dey hide for corner, or di outbreak wey dey
    dabaru for afternoon.
  7. One thousand pipo fit fall for your side and ten thousand for your right hand,
    but e no go come near where you dey.
  8. You go only see am wit your eyes con see as Baba-God go take punish wicked
    pipo.
  9. If you make your caban be di Most High—even di Lord wey I dey hide my head
    put—
  10. naso no bad tin go come where you dey and no palava go come near your
    crib.
  11. He go yarn di angels make dem protect you to guard you for all your ways;
  12. dem go hold your hand make you no nack your leg for stone.
  13. You go waka ontop di lion and cobra; you go match ogbonge lion and snake.
  14. Baba-God sey, “I go save am becos he love me, I go protect am becos he
    respect my name.”
  15. He go call me and I go ansa am; I go dey wit am wen yawa gas. I go free am
    con honor am.
  16. I go give am long life brekete, con show am my salvation.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now