Psalm Chapter 112
Pesin Wey Dey Fear Baba-God Dey Prosper
- Praise Baba-God. Blessings for di man wey dey fear Baba-God, wey Baba-God commandments dey tortori am.
2. Hin pikin go strong kakaraka for earth; di generation of pipo wey get clean-hand go dey blessed.
3. Wealth and plenty moni go dey inside hin house, and hin good works go last forever.
4. Even for inside darkness—light go show for pipo wey get clean-heart; he get fine heart, get soft-heart well- well, and he get clean-heart.
5. Beta pipo dey kind, and dem dey borrow to odas, he go do hin business wit hin church-mind.
6. Surely, no-shaking for am; dem go remember good pipo forever.
7. He no go fear any bad news; hin heart dey kamkpe—to trust Baba-God.
8. Hin heart stand gidigbam, he no go fear until he see hin wish for hin enemies.
9. He don scata hin gifts abroad to poor pipo, and dem go remember hin good works forever; and hin horn go get levels wit respect.
10. Wicked man go see am con para, he go bite hin teeth wit
Questions about Psalm 112
What is Psalm 112 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 112 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-112/
Where can I read Psalm 112 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 112 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-112/
Which Bible book contains Psalm 112?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 112?
The chapter identified by this reference is 112.
Topics connected to this passage
- Faith
- Fear
- Strength
- Money
- Worship