Psalm Chapter 127
Prosperity Na From Baba-God
1. Dis na song of rising. Of Solomon. Unless Baba-God build di house, di builders dey build in vain. Unless Baba-God watch di city, di vigilante dey waste dia time.
2. E no-make-sense to wake up for early mor-mor, con come back late for night—dey hustle hard for food to chop—na Baba-God dey give rest to those pipo wey he love.
3. Na Baba-God dey dash pipo pikin, and babies blessings from Baba-God.
4. Pikin wey pesin born for hin youth—be like arrows for warrior hand.
5. Blessings for di man wey get plenty pikin like bag of arrow, shame no go catch dem wen dem face dia enemies for gate.
Questions about Psalm 127
What is Psalm 127 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 127 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-127-2/
Where can I read Psalm 127 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 127 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-127-2/
Which Bible book contains Psalm 127?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 127?
The chapter identified by this reference is 127.
Topics connected to this passage
- Love
- Peace