Psalm Chapter 135

Abeg share

Di Real God Plus Idols

  1. Praise Baba-God. Praise Baba-God name; praise am, oh servants of di Oga.

2. You wey dey serve for Baba-God house, inside di yard of di house of awa God.

3. Praise Baba-God, Baba-God good; e make-sense to sing praises to hin name.

4. Baba-God don choose Jacob as hin own, and Israel as hin special property.

5. I know sey Baba-God na ogbonge, and he high pass everi gods.

6. Baba-God dey do anytin wey he like, for inside heaven and for earth, for inside di big-rivers and for all deep places [under-under everi big-big-river].

7. He make cloud rise from where di earth end; he send lightning for di rain, and he bring heavy-breeze from where he keep am.

8. He nack di first born of Egypt for ground, di first pikin of men and animals.

9. He send hin signs plus wonders for Egypt—against Pharaoh and all hin pipo.

10. He nack many nations down, and he kill many great kings—

11. Sihon wey be di king of Amorites, Og wey be di king of Bashan, plus all di kings of Canaan—

12. and he give dia land to hin own pipo Israel—as dia property.

13. Oh Baba-God, your name go last forever, and all generations go remember your name.

14. Baba-God go give justice to hin pipo, con show hin servants hin soft-heart.

15. Di idols of di nations na silver plus gold—wey men use dia hand make.

16. Dem get mouth, but dem no-fit tok, dem get eyes, but dem no-fit see;

17. dem get ears, but dem no-fit hear, and dem no-fit breath wit dia mouth.

18. Those pipo wey make dem be like dem, and naso pipo wey trust dem be sef.

19. Praise Baba-God—Oh house of Israel; oh house of Aaron—praise Baba-God;

20. Oh house of Levi—praise Baba God; make pipo wey dey fear am—praise am.

21. Praise be to Baba-God from Zion, praise be to am wey dey stay for Jerusalem. Make una praise Baba-God.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *