Proverbs Chapter 1
Di Starting of Knowledge
- Dis na di proverbs of Solomon, David
pikin, King of Israel. - Dis proverbs go make you sabi wise, and
sabi learn, to fit understand di yarnings of
understanding, - to sabi di teaching of wisdom, of justice,
judgement, and how to do tins wit your
church-mind. - Dis proverbs go give sense to ordinary
pipo, e go make young pipo sabi, and e go
make dem cool down—con reason life. - Make wise pipo listen to sabi more-more,
and make pipo wey fit understand—get
guidance. - Make dem sabi understand proverbs and
parables, plus di yarnings and twist-tok of
wise man.
Fashi Evil Advice - To fear Baba-God na di starting of
knowledge, but mumu pipo dey fashi
wisdom plus learning. - My son, hear your papa word and make
you no fashi wetin your mama teach you. - E be like flower wey dem use make crown
for your
head, and chain wey dey make your neck
fine. - My pikin, if bad pipo dey make your eyes
shuuk wit dia sweet-mouth, make you no
send dem. - If dem tok sey, “Come follow us, make
we wait for pesin wey we go kill, make we
hide for corner to waste innocent soul; - make we chop dem alive like grave, like
deadbody wey dem wan bury for pit. - We go collect beta tins from dia
hand—con carry wetin we obtain go full awa
house, - stay wit us, follow us, and we go share
wetin we collect.” - My pikin, make you no follow dem, no
waka pass dia way; - dia leg go put dem for wahala, and dem
dey fast to waste pesin blood. - Pesin wey set net as di bird dey look am,
dey set di net in vain. - Dis men dey wait for corner for dia own
blood; and dem go kill demsef wit dia own
hand! - Naso pipo wey make dia moni wit bad
way take dey kpeme; dat kain moni dey kill
di pesin wey get am.Wisdom Dey Call - Wisdom dey halla for street, she dey sing
for village square; - she dey sing for front of street wey dem
dey make noise well-well, she dey tok for di
gate of di city. - “My pipo, shey na like dis una go dey
dey? How long mumu pipo go just dey tok
and laff, and mumu pipo no wan learn
anytin? - Follow my teachings, I go surely pour my
spirit give you, and I go make you sabi my
words. - But as you con fashi me wen I dey call
you, and no-pesin reason my mata wen I
stretch my hand, - you bone all my advice, and you no gree
hear me wen I correct una; - me sef go use you laff wen una palava
start; I go yab you wen your yawa gas— - wen your fear come like strong breeze,
wen scata-scata come like rolling-breeze,
and wen palava and gbege full your head. - “Dat time dem go call me, but I no go
ansa; dem go fyne me taya, but dem no go see
me. - As dem no like to learn, and dem no like
to respect Baba-God, - as dem no gree hear my advice, con fashi
everitin wey I dey tell dem. - So dem go chop di fruit of dia own
way, and dem go belleful wit di fruit of dia
own ideas. - Ordinary pipo dey kpeme becos dem turn
komot from di right way, and mugu wey no
wan gree grow go kpeme. - But any-pesin wey dey hear wetin I dey
tok—go dey safe for where e dey stay, and he
go dey secured—wit-out di fear evil.