Proverbs Chapter 19
E Beta Make You Be Poor Man Wey Get Clean-hand
- E beta make pesin be poor man wit
clean-hand, dan make pesin be lie-lie and
mugu. - E no good make pesin be olodo, and pesin
wey dey rush—go commit error. - Na di mumu way of man, dey make hin
road get k-leg, and he go still dey para for
Baba-God. - Wealth dey bring plenty padi, but poor
man padi go fashi am. - Baba-God must punish lie-lie witness, and
any-pesin wey dey always tok lie no go go
free. - Plenty pipo dey fyne favour from bigman,
and everi- pesin na padi of man wey sabi give
gift. - Poor man brodas hate am—tokless of hin
padi wey go run from am! Even though he
dey beg to see dem, dem no go gree see am. - Any-pesin wey get wisdom love hin own
soul; and pesin wey like understanding go
see alubarika (blessings). - Baba-God must punish lie-lie witness, and
any-pesin wey dey tok lie go kpeme. - Expensive life no-fit mugu—tokless of
make slave dey rule princes! - Man wisdom go make am no dey
quick vex; na levels for man to bone pesin
wey offend am. - Wen king para, e be like wen lion dey
halla, but king favour be like showers on top
of grass. - Mumu pikin go fall hin papa hand, and
wife wey like wahala—be like wen rain no
wan gree stop. - Na from papa and mama dem take dey
collect properties and wealth, but na Baba-
God dey give pesin—wife wey get-sense.
15 Laziness dey make pesin sleep deep, and
man wey no wan hustle go hungry die. - Pesin wey dey keep di commandment
dey guard hin life, but pesin wey no dey
reason hin way go kpeme. - Pesin wey kind to poor pipo, don borrow
Baba-God moni, and Baba-God go pay am
for wetin he don do. - Correct your pikin wen hope still dey; no
put your mind on wetin go spoil am. - Man wey dey vex seriously must pay for wetin he don do; if you save am once, you go still need to sorry-for am again.
- Dey hear advice, accept wetin dem dey
teach you, and las- las you go wise. - Man get plenty plans for hin heart, but na
Baba-God plan for hin life nahin go stand. - Wetin man want na love. E beta make
you poor, dan make you be lie-lie. - Di fear of Baba-God dey lead to life, and
pesin wey get am go belleful forever, and
wahala no go fit reach where he dey stay. - Lazy man put hin hand for inside plate;
and he no-fit carry hin hand put back for hin
mouth! - Flog mugu and pipo go get-sense.
Correct man wey get understanding, and he
go sabi sometin. - Pikin wey do hin papa anyhow, con
pursue hin mama komot, na pikin wey dey
bring shame plus disgrace. - My pikin, if you stop to dey listen to
wetin dem dey teach you, you go waka
komot from words of knowledge. - Corrupt witness dey use justice play, and
wicked pesin mouth dey chop evil. - Punishment dey wait for mumu pipo, and
beating must touch swegbe back.
Questions about Proverbs 19
What is Proverbs 19 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 19 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-19/
Where can I read Proverbs 19 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 19 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-19/
Which Bible book contains Proverbs 19?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 19?
The chapter identified by this reference is 19.
Topics connected to this passage
- Love
- Hope
- Salvation
- Wisdom
- Fear
- Family
- Money
- Guidance