Proverbs Chapter 25
More Proverbs Of Solomon
- Dis one sef na more proverbs of King
Solomon, wey Hezekiah, king of
Judea—men write down. - Na levels for Baba-God to code mata; and
na levels for king to understand mata. - As heaven high reach, and as earth deep
reach, naso dem no-fit reason wetin dey for
inside oba heart. - Komot di waste material from silver, and
di silversmith go fit produce jewelry. - Komot wicked pipo from king side, and
hin king-chair go stand gidigbam wit
goodness. - No make-mouth for king front, and no go
claim sey you be great man; - e beta make he tell you sey, “Come up
here,” dan make he fall your hand for front of
di princes. Wetin you don see wit your eyes, - no carry am rush go court, wetin you go do
if your neighbour con make shame catch you
las-las? - If you dey argue mata wit your neighbour,
no open anoda pesin secret, - or if any-pesin hear am, shame go catch
you and your name go spoil. - Word wey pesin tok for di right time—be
like golden apple for silver basket. - To use wisdom criticize pesin wey dey
hear word—be like gold earring or fine
jewelries. - Messenger wey dem trust—be like di
cold snow for harvest time—to di pipo wey
send am; he dey ginger di spirit of hin oga. - Like cloud and heavy- breeze wey no
gree bring rain, naso man wey dey make-
mouth wit gift wey he no-fit give—be. - Na wit serious patience you go fit beg king, and soft tongue fit break bone.
- If you see honey, chop di one wey you fit
chop—if you chop too much, you go start to
dey vomit. - No dey too go your neighbour house—or
dem go taya for you, con start to dey hate
you. - To lie for your neighbour head, be like
sey make you nack am wit kpako, or shuuk
am wit sword, or sharp arrow. - To trust unfaithful pesin wen yawa gas,
be like make your teeth dey pain you, and e
be like make your leg shift from e joint. - Like pesin wey komot hin cloth for cold
weather, or like pouring ogogoro on top
wound—naso e be to sing for pesin wey no
get joy. - If your enemies dey hungry, give dem
food to chop; if he wan drink water, give am
water drink. - If you do like dat, you don put hot
charcoal for hin head, and Baba-God go pay
you. - As north breeze take dey carry rain come,
naso pesin wey get amebor tongue—dey
make face spoil. - E beta make you dey stay for one corner
of roof, dan make you dey stay for di same
house wit woman wey like quarrel. - As cold water be for soul wey don taya,
naso good news be—from abroad. - Good man wey give wicked man
chance—be like water wey full wit portor-
portor, and well wit bad water. - E no good to chop too much honey, and
naso e be sef wen pesin dey fyne praise from
pipo—no be levels be dat. - Man wey no-fit control hinsef, be like
city wey e wall don kpafuka.
Questions about Proverbs 25
What is Proverbs 25 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 25 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-25/
Where can I read Proverbs 25 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 25 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-25/
Which Bible book contains Proverbs 25?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 25?
The chapter identified by this reference is 25.
Topics connected to this passage
- Faith
- Wisdom
- Worship