Isaiah Chapter 25
Song of Praise For Baba-God Favour
- Oh my Oga, na you be my God; and I go give you levels, I go praise your name, becos you don do ogbonge tins, your olden days wisdom na faithfulness plus truth.
- You don make di city scata for ground, and city wey get wall don turn to scata-scata; palace where strangers dey stay—wey no be city, and dem no go fit build am again.
- So di strong pipo go give you levels, di city of di wicked nations go fear you.
- Becos you don be strength for poor pipo, and pawa to pipo wey need urgent epp, place wey pesin fit hide from heavy-breeze, shade from di heat, wen di breath of di wicked pipo be like heavy-breeze wey dey push di wall.
- You go bring down di noise of foreign nations—like di heat for dry place; just as shade of cloud dey make heat calm down; di branch of di wicked pipo go cut down.
- And na for dis mountain (Zion) Baba-God Almighty go make big party for hin pipo. E go be sweet party wit ogogoro wey don konk (old wine), beta meat, beta wine, and good food.
- Na for dis mountain Baba-God go scata di tins wey dem cast to cover all di pipo, plus di face mask wey cover everi nation.
- He go swallow death as he dey win, and Baba-God go komot tears from everi face, and he go komot di punishment from hin pipo, from di whole earth—Baba-God don tok am.
- On dat day, di pipo go tok sey, “Dis na awa God, we don wait for am, and he go save us. Dis na Baba-God, we don wait for am, we go happy, con dey jolly sey he save us.
- Baba-God go rest hin hand on dis mountain, and he go march Moab under hin leg, even as dem dey march grass for where dem gada manure.
- Baba-God go spread hin hands among dem, just as pesin wey dey swim take dey spread hin hand to swim, and he go scata dia high-shoulder togeda wit all di tins wey dem don obtain.
- Baba-God go bring down di strong-house of dia wall—and he go bring dem reach ground—even reach dust.