Jeremiah Chapter 45

Abeg share

Jeremiah Message to Baruch

  1. Na wetin prophet Jeremiah tell Baruch wey be di son of Neriah for di fourth year of Jehoiakim wey be di son of king Josiah di king of Judah, afta Baruch don write di words wey Jeremiah tell am to write for book:
  2. Baruch, dis na wetin Baba-God dey tell you, di God of Israel,
  3. “You tok sey wahala for me now, becos Baba-God don add sadness join my pain; I don taya to dey cry, and rest no dey for me.”
  4. Baba-God tok sey, “Tell am dis tin: Dis na wetin Baba-God tok: I go scata wetin I don build, con komot di root of wetin I don plant tru-out di land.
  5. Abi you go con dey fyne great tins for yoursef? No fyne dem. Becos I go carry wahala come meet all di pipo,” naso Baba-God tok, “But I go allow you escape wit your life anywhere wey you go.”

Questions about Jeremiah 45

What is Jeremiah 45 in Pidgin Bible?

This page contains Jeremiah 45 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/jeremiah-chapter-45/

Where can I read Jeremiah 45 in Nigerian Pidgin?

You can read Jeremiah 45 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/jeremiah-chapter-45/

Which Bible book contains Jeremiah 45?

Jeremiah is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Jeremiah 45?

The chapter identified by this reference is 45.

Topics connected to this passage

  • Peace

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now