Hosea Chapter 9
Hosea Tok About Israel Punishment
- Make una no dey happy, oh Israel, like di happiness of oda pipo, becos una don turn to olosho, con turn komot from Baba-God. Una love di salary of ashawo work for everi harvest ground [by praising Baal for una harvest instead of Baba-God].
- Di harvest ground plus di wine-factory no go feed dem, and di new wine go go dey for her.
- Dem no go stay for Baba-God land, but Ephraim go go back to Egypt, and dem go chop food wey no clean for Assyria.
- Dem no go give drink offerings to Baba-God, and he no go gbadun dia sacrifice. E go be like burial food to dem; everi pesin wey chop am go corrupt. Dem fit chop dis food for demsef, but make dem no give am to Baba-God.
- Wetin you go con do on di day of festival? How you go take keep Baba-God festival?
- Dem don true-true komot becos of scata-scata. Egypt go gada dem; Memphis go burry dem. Nettles [wild flowers] go grow for di fine places of dia silver; shuuku-shuuku go grow for dia houses.
- Di days of punishment don show; di days of judgement don land. Israel go know! Di prophet na mumu, di spiritual man don mad, becos of how una sins plenty reach, and becos of una serious badbelle.
- Di prophet na watchman of Israel for my God, but dem dey set trap for am any where he go. Dem dey change-am-for am—even for inside di house of hin God.
- Dem don corrupt demsef well-well just like di days of Gibeah. So he go remember dia sins, and he go punish dem for di bad-bad-tins wey dem don do.
- Wen I first see Israel, e be like sey pesin see fresh grape for inside desert. Wen I see una ancestors, e be like wen pesin see di first ripe fig fruits of di season. But dem fashi me for Bal-Peor, and dem separate demsef to dat shame; dem turn to tufiakwa like di tin wey dem love.
- As for Ephraim, dia levels go fly komot like bird—no pesin go born pikin, no pesin go get-belle, and no pesin go carry pikin.
- Even though dem train dia pikin, I go kill all of dem, and dem go cry becos no single man remain. Yes, wahala for dem wen I fashi dem!
- Just as I take see Ephraim like Tyre wey dey grow for fine place, but Ephraim go carry hin pikins come out for killer.”
- “Oh Baba-God, give dem [wetin dem deserve]—wetin you go give? Give dem belle wit pikin wey don die inside, and dry breasts!
- All dia wickedness dey for Gilgal, na for there I hate dem. Becos of di evil tins wey dem do, I go pursue dem komot from my house; I no go love dem again. All dia princes no dey obey me.
- Dem don nack Ephraim, dia root don dry; dem no go produce any fruit. Yes, and even if dem born pikin, I go kill dia small pikin wey dey make dem happy.”
- My God go pursue dem komot, becos dem no gree obey am; and dem go dey waka-waka among di nations.