Hosea Chapter 14
Message For Dem To Repent
- Oh, Israel, make una come back to una God, becos una sins don make una fall yakata.
- Bring your words of confession, and turn back to Baba-God. Tell am sey, “Carry all di sins komot, so dat we go fit praise you wit awa lips.
- Assyria no go save us; we no go ride horses for war; and we no go ever tell di idols wey we make wit awa hand, sey, ‘Na you be awa God.’ Na you dey sorry-for pipo wey no get papa and mama.”
Di Promise of Baba-God Blessing
4. I go heal dem as dem turn komot from me; I go love dem wit free mind, becos my vex don turn komot from dem.
5. I go be like dews to Israel; he go grow like lily flower; hin root go grow enta ground well-well like di cedar trees of Lebanon;
6. Hin branches go spread out; he go fine like di olive trees, and he go dey scent like di cedars of Babylon.
7. My pipo go live under e shade again, and dem go grow like corn, con grow like grape-farm. And dia scent go be like di wine of Lebanon.
8. “Ephraim go tok sey, ‘Wetin I still dey do wit idols? Na me dey ansa una prayers, and I care about una. I be like green cypress tree; all una fruits dey for my body.”
9. Who wise? Make he understand dis tins. Who get-sense?—make he sabi dis tins. Baba-God ways na correct ways; beta pipo go waka for di ways, but sinners dey fall yakata for inside those ways.