Exodus Chapter 40
Dem Set Di Worship-place
- Naso Baba-God tell Moses sey,
- “Set up di worship-place, for di first day of di month.
- Put di ark (box wey di ten commandments dey inside) inside di worship-place, con use di curtain take guard di ark.
- Carry di table come inside, con set di tins wey suppose dey on am, den bring di lampstand, con set di lamps.
- Put di golden altar for burning incense for front of di holy ark, con put di curtain for di doormot of di worship-place.
- Put di altar of burnt offering for front of di doormot of di worship-place, di Tent of Meeting;
- Put di basin between di worship-place and di altar, con pour water put inside.
- Set di yard round am, con put di curtain for di doormot of di yard.
- Take di anointing ororo, use am take anoint di worship-place, plus everitin wey dey inside am, give dem to Baba-God plus all di properties, and dem go holy.
- Den you go anoint di altar of burnt offering, plus all e tins, bless di altar for Baba-God, and e go dey holy well-well.
- Anoint di basin plus e stand, con bless am to make am holy.
- “Bring Aaron plus hin sons come front of di worship-place, con wash dem wit water.
- Den wear Aaron di holy clothes, con anoint am, con bless am to make am holy—so dat he go serve me as priest.
- Bring hin sons come, con wear di long-sleeve-gown for dia body.
- Anoint dem just as you take anoint dia papa, so dat dem go fit serve as priests, and dia generations go be priests forever.”
- Moses do everitin just as Baba-God tell am.
- So dem set up di worship-place on di first day of di month for di second year.
- Wen Moses set up di worship-place, he put di solid-bottoms for dia place, con stand di frames, he set di crossbar, con set up di pillars.
- So he spread di tent on top of di worship-place, con put di cover of di tent, just as Baba-God command am.
- He carry di ten commandment wey dey for stone, con put am inside di ark, he fix di poles to di ark, con put di mercy chair (ark cover) on top.
- Naso he carry di ark enta di worship-place, con hang di curtain wey dey guard am, he use di curtain take guard di ark of Baba-God word—just as Baba-God tell am.
- Moses put di table inside di worship-place for di north side of di worship-place—outside di curtain,
- He put bread on top of di table as offering for Baba-God, just as Baba-God bin tell am.
- He put di lampstand inside di worship-place, opposite di table for di south side of di worship-place,
- He con set di lamps for front of Baba-God, as Baba-God tell am.
- Moses put di gold altar for inside di worship-place, for front of di curtain,
- Con burn incense wey get sweet scent on top of am, as Baba-God bin tell am.
- Naso he set di curtain for di doormot of di worship-place.
- He set di altar of burnt offerings plus seed offerings, just as Baba-God bin tell am.
- He put di basin between di worship-place and di altar, con put water inside am for washing.
- So Moses, and Aaron plus hin sons use di water take wash dia legs.
- Dem wash dia legs any time wey dem enta di worship-place or wen dem wan near di altar, just as Baba-God bin tell Moses.
- Den Moses set up di yard around di worship-place and altar, con put di curtain for di doormot of di yard. Naso Moses take finish di work.
Baba-GodLevels
34. Moses no fit enta inside di worship-place, becos di cloud don settle put on am, and di levels of Baba-God brekete for inside di worship-place.
35. For all di waka-waka wey di pipo of Israel do, any time wey di cloud raise komot from di worship-plac—dem go start dia movement.
36. But if di cloud no raise up, di pipo of Israel no go move—until di day wey di cloud go rise.
37. Baba-God cloud con dey on top of di worship-place for day time, and faya inside di cloud for night, for front of all di pipo of Israel as dem dey travel.