Proverbs 25
More Proverbs Of Solomon
- Dis one sef na more proverbs of King Solomon, wey Hezekiah, king of Judea—men write down.
- Na levels for Baba-God to code mata; and na levels for king to understand mata.
- As heaven high reach, and as earth deep reach, naso dem no-fit reason wetin dey for inside oba heart.
- Komot di waste material from silver, and di silversmith go fit produce jewelry.
- Komot wicked pipo from king side, and hin throne go stand gidigbam wit righteousness.
- No make-mouth for king front, and no go claim sey you be great man;
- e beta make he tell you sey, “Come up here,” dan make he fall your hand for front of di princes. Wetin you don see wit your eyes,
- no carry am rush go court, wetin you go do if your neighbour con make shame catch you las-las?
- If you dey argue mata wit your neighbour, no open anoda pesin secret,
- or if any-pesin hear am, shame go catch you and your name go spoil.
- Word wey pesin tok for di right time—be like golden apple for silver basket.
- To use wisdom criticize pesin wey dey hear word—be like gold earring or fine jewelries.
- Messenger wey dem trust—be like di cold snow for harvest time—to di pipo wey send am; he dey ginger di spirit of hin oga.
- Like cloud and heavy-breeze wey no gree bring rain, naso man wey dey make-mouth wit gift wey he no-fit give—be.
- Na wit serious patience you go fit beg king, and soft tongue fit break bone.
- If you see honey, chop di one wey you fit chop—if you chop too much, you go start to dey vomit.
- No dey too go your neighbour house—or dem go taya for you, con start to dey hate you.
- To lie for your neighbour head, be like sey make you nack am wit kpako, or shuuk am wit sword, or sharp arrow.
- To trust unfaithful pesin wen yawa gas, be like make your teeth dey pain you, and e be like make your leg shift from e joint.
- Like pesin wey komot hin cloth for cold weather, or like pouring ogogoro on top wound—naso e be to sing for pesin wey no get joy.
- If your enemies dey hungry, give dem food to chop; if he wan drink water, give am water drink.
- If you do like dat, you don put hot charcoal for hin head, and Baba-God go reward you.
- As north breeze take dey carry rain come, naso pesin wey get amebor tongue—dey make face spoil.
- E beta make you dey stay for one corner of roof, dan make you dey stay for di same house wit woman wey like quarrel.
- As cold water be for soul wey don taya, naso good news be—from abroad.
- Righteous man wey give wicked man chance—be like water wey full wit portor-portor, and well wit bad water.
- E no good to chop too much honey, and naso e be sef wen pesin dey fyne praise from pipo —no be levels be dat.
- Man wey no-fit control hinsef, be like city wey e wall don kpafuka.