Blog

Your blog category

  • Galatians Chapter 1

                               To Di Churches Wey Dey For Galatia: 3. Make Baba-God awa Papa, plus Oga Jesus Christ, give una grace plus peace. 4. Jesus Christ sacrifice hinsef for awa sins, to save us from dis evil generation wey dey now, based-on di will of Baba-God, and awa Papa. 5. All di glory to Baba-God for ever and ever! Iseeee [Amen]. Anoda Good Message No Dey 6. E dey surprise me sey, una sharply fashi Baba-God wey call una wit di grace of Christ, and as una take komot go face anoda different preaching— 7. wey no be Baba-God word at all. But some pipo dey give una wahala, and dem…

  • Galatians Chapter 2

    Di Disciples Accept Paul Paul Change-am-for Peter 11. Wen Peter come Antioch, I change-am-for am korokoro, becos he dey do wrong tin. 12. Wen he first come, he bin dey chop wit some uncircumcised Gentiles (world-pipo). But later, wen some of James padi show, he con stop to dey mix wit di Gentiles [world-pipo]. becos he dey fear those pipo wey believe sey pesin must circumcise. 13. Becos of dat, some oda Jews join am for hin fake-life, sote Barnabas con dey waka-lose becos of hin fake-life. 14. Wen I see sey dem no dey follow di truth of di good news, I tell Peter for all of dem front…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now