Deuteronomy Chapter 34
Moses Kpeme For Mountain Nebo
- Naso Moses go up from di smooth-land of Moab, con go mountain Nebo, on top of Pisgah, wey dey for opposite Jericho. So Baba-God show am all di land of Gilead, far-far go reach Dan,
- di whole of Naphtali, plus di land of Ephraim and Manasseh, all di land of Judah, far-far go reach di Big-river for di west [Mediterranean Sea],
- di south, plus di smooth-land wey dey for bottom-of- di-mountain of Jericho, di city of Palm Trees, far-far go reach Zoar.
- Naso Baba-God tell am sey, “Na dis be di land wey I swear to give Abraham, Isaac, plus Jacob, wen I tok sey, ‘I go give am to una pikin-pikin-pikin.’ I don let you see am wit your eyes, but you no go cross go there.”
- So Moses wey be Baba-God servant con kpeme for there, for di land of Moab, just as Baba-God bin tok.
- And dem bury am for bottom-of-di-mountain for di land of Moab, opposite Bethpeor; but know pesin know where hin grave day till today.
- Moses na 120 year old wen he die. Hin eyes still dey see well and hin natural pawa still dey.
- So di pikins of Israel cry for Moses for di smooth-land of Moab for thirty days. And di days of crying and mourning for Moses con finish.
- Now Joshua wey be di son of Nun brekete wit di spirit of wisdom, becos Moses bin lay hin hand on am; so di pipo of Israel con dey follow hin word, and dem do wetin Baba-God bin tell Moses.
- But since den, e no get any oda prophet for Israel wey be like prophet Moses, wey Baba-God tok to face to face,
- Inside all di signs and wonders wey Baba-God send am to do inside di land of Egypt, for Pharaoh front, for front of hin servants, and for front of di whole land,
- And by all di ogbonge pawa, plus all di strong tins wey he do for front of di pipo of Israel wey make dem fear.