Leviticus Chapter 12
To Clean Women Afta Dem Born Pikin
- Naso Baba-God tell Moses sey,
- “Tell di pipo of Israel sey: ‘Woman wey get belle, con born baby boy, dem go clean her body for seven days, just as she no dey clean for di days of her period.
- On di eighth day, make una circumcise di boy.
- Den di woman must wait for thirty three days to clean from di blood wey dey flow komot from her body. She must no touch anytin wey holy, or enta di holy-place until she finish di days of her cleaning.
- If she born baby girl, na for two weeks di woman no go dey clean, as she always dey for di time of her period. Naso she must wait for sixty-six days so dat she go clean kpatakpata.
- “Wen di days for di cleaning for her son or daughter don finish, make she carry one year old lamb for burnt offering, and one young pigeon or one dove for sin offering—come meet di priest for front of di door of di worship-place.
- Di priest go give dem for Baba-God front, con sacrifice for her sins, and she go dey clean from her flow of blood. Dis na di law for woman wey born pikin, whether na boy or girl.
- If she no fit bring lamb, make she bring two doves or two young pigeons, one for burnt offering, and di oda one for sin offering. Naso di priest go take sacrifice for her sins, and she go clean.
Questions about Leviticus 12
What is Leviticus 12 in Pidgin Bible?
This page contains Leviticus 12 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/leviticus-chapter-12/
Where can I read Leviticus 12 in Nigerian Pidgin?
You can read Leviticus 12 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/leviticus-chapter-12/
Which Bible book contains Leviticus 12?
Leviticus is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Leviticus 12?
The chapter identified by this reference is 12.
Topics connected to this passage
- Hope
- Forgiveness
- Worship