Leviticus Chapter 2

Abeg share

Di Seed Offering

  1. “Wen pesin dey give seed offering to Baba-God, make hin offering be fine flour. Make he pour ororo put on am, con put incense on am.
  2. Make he carry am go meet Aaron sons wey be di priests. Di priest go use hin hand take pack di flour and ororo, togeda wit all di incense, con burn part of am for di altar as sample. Na special offering wey dem make wit faya, sweet scent wey Baba-God like.
  3. Di rest of di seed offering belong to Aaron plus hin sons; na di most holy part of di offering wey dem give to Baba-God wit faya.
  4. “If you bring seed offering wey dem bake for oven, make am wit fine flour: make e be cake wit no yeast and wey dem mix wit ororo, or thin cakes wey dem make wit-no yeast and wey dem rub ororo put.
  5. If you bake your seed offering for pan, you must make am wit no yeast and wey una make wit di best flour.
  6. Cut am to pieces, con pour ororo put on am; na seed offering.
  7. And if your seed offering na di one wey dem bake for frying pan, make am wit fine flour and ororo.
  8. Bring di seed offering wey you make wit all dis tins come meet Baba-God; carry am give di priest wey go carry am go di altar.
  9. Di priest go carry part of am as sample, and he go burn am for di altar. Na special offering wey dem make wit faya. Na sweet scent wey Baba-God like.
  10. Di rest of di seed offering belong to Aaron plus hin sons; na di most holy part of di offering wey dem make to Baba-God wit faya.
  11. “Una must no use yeast take make any seed offering wey una wan give Baba-God, una must no burn any yeast, or any honey—for any offering wey una dey give Baba-God wit faya.
  12. As for offering of firstfruits, you fit bring dem to Baba-God as offering, but make you no burn dem for altar as sweet scent.
  13. Use salt prepare all una seed offerings. Becos salt represent di agreement between you and Baba-God. You must add salt to all una offerings.
  14. “If you bring seed offering of firstfruit to Baba-God, bring fresh seed wey dem grind, con roast for faya.
  15. Put ororo and incense on am; na seed offering.
  16. Di priest go burn part of di seeds wey dem grind, as sample, wey dem rub wit ororo, togeda wit all di frankincense, con burn am as special offering to Baba-God—wey dem make wit faya.

Questions about Leviticus 2

What is Leviticus 2 in Pidgin Bible?

This page contains Leviticus 2 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/leviticus-chapter-2/

Where can I read Leviticus 2 in Nigerian Pidgin?

You can read Leviticus 2 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/leviticus-chapter-2/

Which Bible book contains Leviticus 2?

Leviticus is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Leviticus 2?

The chapter identified by this reference is 2.

Topics connected to this passage

  • Peace

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now