Luke Chapter 11

Abeg share

Jesus Teach About Prayers

  1. One day, Jesus dey pray for one place. Wen he finish, one of hin disciple con tell am sey, “Oga, teach us how to pray, just as John take teach hin disciples.”
  2. So Jesus tell dem sey, “Wen una wan pray, sey: ‘Awa Papa wey dey for heaven, we hail your name wey dey holy, make your kingdom come. Make your plan show for earth—as e dey for heaven.
  3. Give us wetin we go chop everi day.
  4. Forgive us awa sins, as we sef dey forgive everi-pesin wey sin against us. No carry us go meet temptation, but save us from evil.’

Ask, Fyne, Knock

5. He con tell dem one tori, “If to sey one of una get one padi, and you go meet am for midnight, con tok sey, ‘Aboki, biko epp me wit three bread,

6. becos one of my padi travel come see me, and I no get anytin to give am chop.’

7. “Naso di one wey dey inside go ansa am sey, ‘No disturb me joor. Di door don already lock, and my pikin dey wit me for bed. I no fit stand up to give you anytin.’

8. I dey tell una sey, he no go stand up to give am di bread becos na hin padi; but becos he kontinu to dey knock, he go stand up to give am wetin he want.

9. “So I dey tell una: Ask—and you go get wetin you ask for; fyne—and you go see wetin you dey fyne; knock—and di door go open for you.

10. everi-pesin wey ask—go receive; pesin wey fyne—go see wetin e dey fyne; and pesin wey knock—di door go open for am.

11. “Which of una wey be papa, if your pikin ask for fish, you go con give am snake instead?

12. Or if e ask for egg, you go con give am scorpion?

13. If una wey be evil pipo sabi give beta gift to una pikin, how much more una Papa wey dey for heaven—go give di Holy Spirit to those pipo wey ask am!”

Jesus Plus Evil Spirit

14. One day, Jesus dey pursue one bad-spirit komot from one man wey no fit tok. Wen di bad-spirit komot, di man wey no fit tok—con dey tok, and di plenty pipo surprise.

15. But some of dem tok sey, “He dey pursue di bad-spirit wit di pawa of di prince of demon.”

16. Odas con test am—as dem dey ask am for sign from heaven.

17. Jesus know wetin dem dey tink, he con tell dem sey: “Any kingdom wey dey fight esef go dabaru, and house wey dey fight esef go fall.

18. If Satan dey fight hinsef, how hin kingdom go take stand? I dey tok dis one becos una tok sey I dey drive bad-spirit komot wit di pawa of di prince of demon.

19. Now if I drive bad-spirit komot wit di pawa of di prince of demon, which pawa una sons dey use drive dem komot? So na dem go judge una.

20. But if I drive bad-spirit komot wit Baba-God pawa, den Baba-God kingdom don come meet una.

    21. “Wen strong man wey dey fully armed—guard hin own house, hin property go dey safe.

    22. But wen pesin wey strong pass am—attack am, con over-pawa am, he go carry hin weapon wey di man trust, con collect di man property.

    23. “Pesin wey no dey wit me—dey against me, and pesin wey no dey work wit me—dey work against me.

    24. “Wen evil spirit komot from pesin body, e go go empty place, con dey fyne where to rest, and if e no see any place to rest.E go con tok sey, ‘I go go back to di house wey I komot from.’

    25. So wen e come, e go see sey dem sweep di place clean, and everi-where dey okay.

    26. Naso e go con go carry seven spirits wey bad pass am, and dem go stay for there. And di man condition las-las—go bad pass as e be before-before.”

    27. As Jesus dey tok dis tins, one woman among di plenty-pipo con halla, “Blessings for di mama wey born you, con give you breast suck.”

    28. Naso Jesus ansa, “Instead, blessings for those pipo wey hear Baba-God word, con obey am.”

    Di Sign Of Jonah

    29. As di pipo wey gada dey plenty more-more, Jesus con tok sey, “Dis na wicked generation. Dem dey ask for miracle sign, but dem no go see any sign. Except di sign of Jonah.

    30. As Jonah be sign to di pipo of Nineveh, naso Man-pikin sef go be sign for dis generation.

    31. Di Queen of di south go stand up for judgement day—against di men of dis generation, con condemn dem; she come from end of di earth to listen to Solomon wisdom, and now pesin wey great pass Solomon dey for here.

    32. Di men of Nineveh go stand up on judgement day—to change-am-for di men of dis generation, con condemn dem; Nineveh repent as dem hear Jonah preaching, and now pesin wey great pass Jonah dey for here.

    Di Lamp Of Di Body

    33. “No-pesin go light lamp con put am for place wey dem no go see am, or for under basket. Instead, he go put am for e stand, so dat those pipo wey enta di house go see di light.

    34. Your eye na di lamp of your body. Wen your eye good, your whole body go brekete wit light. But wen your eye na evil, your body go burku wit darkness.

    35. Make sure sey di light wey dey inside you—no be darkness.

    36. So if your whole body brekete wit light, and no part of am dark, e go shine fully, like sey di light of lamp dey shine for your body.”

    Six Yawa

    37. Wen Jesus don tok finish, one Pharisee invite am make he con chop wit am; so he go, con sidon for table.

    38. But di Pharisee surprise, as he notice sey Jesus no first wash hin hand before he start to dey chop, based-on tradition.

    39. Naso Jesus tell am sey, “Una Pharisees dey clean di outside of cup and plate, but longatrot brekete inside una, plus badbelle.

    40. Mumu pipo! Abi di pesin wey make outside, no be him still make inside?

    41. So clean di inside—by giving to poor pipo, and everitin go clean for you.

    42. Yawa for una Pharisees, becos una dey give Baba-God tithe of mint and rue, plus everi small herbs wey una get, but una fashi justice plus Baba-God love. Una for do dis tins—and no still fashi di oda tins.

    43. “Yawa for una Pharisees, becos una love di high table for worship-place, plus hailings for marketplace.

    44. “Kasala for una, becos una be like graves wey dem no mark, wey men no know—con dey waka pass am.”

    45. One of di men wey sabi di law con ansa am, “Teacher, you dey insult us sef as you dey tok dis tin so.”

    46. Naso Jesus ansa am, “Yawa for una wey sabi di law, becos una dey carry load give pipo—load wey dem no fit carry, to press dem for ground. And una sef no fit move one single finger to epp dem.

    47. “Yawa for una, becos una build graves for di prophets, and na una forefadas nahin kill dem.

    48. So una don confam sey una like wetin una forefadas do; dem kill di prophets, and una build dia graves.

    49. Becos of dis, Baba-God for hin wisdom con tok sey, ‘I go send dem prophets and apostles, dem go kill some of dem, and dem go show some of dem pepper.’

    50. So I go hold dis generation for di blood of all di prophets wey dem don shed since di starting of dis world,

    51. from di blood of Abel to di blood of Zechariah, wey dem kill for di middle of di altar and di holy-place. Yes, I dey tell una, I go hold dis generation for all of dem.

    52. “Yawa for una wey sabi di law, becos una don carry dis key of knowledge. Una sef no gree enta, and una dey block those pipo wey wan enta inside.”

    53. As Jesus dey komot from there, naso di Pharisees plus di teachers of di law seriously start to dey change-am-for Jesus—dem con dey ask am plenty question,

    54. dem wan hollam-for- work wit sometin wey he go tok.

    Leave a Reply

    Your email address will not be published. Required fields are marked *