• Amos Chapter 5

    Burial Song For Israel Israel Need To Repent 4. Dis na wetin Baba-God tell di house of Israel: “Make una fyne me so dat una go live; 5. Make una no fyne Bethel, make una no go Gilead, make una no travel go Beersheba. Becos Gilead go surely enta foreign land as slave, and Bethel go turn to notin.” 6. Fyne Baba-God so dat una go survive, or he go sweep tru di house of Joseph like faya. E go burn am, and Bethel no go see pesin to stop di faya. 7. Una wey dey turn justice to sadness, and una throway goodness put for ground. 8. Him wey…

  • Amos Chapter 6

    Wahala For Pipo Wey Dey Chill For Inside Zion        Israel Dey Carry-shoulder 8. Baba-God Almighty don swear wit hinsef—Baba-God Almighty don yarn sey; “I hate as Jacob dey carry-shoulder, and I hate hin strong-houses; I go give dis city plus everitin wey dey inside am—to dia enemies.” 9. And e go happun sey if na ten men remain for inside one house, dem sef go kpeme. 10. And if family-pipo and pesin wey suppose burn di body come carry dem komot from di house, con tok any pesin wey dey hide for inside-inside, sey, “Abi any oda pesin dey wit you?” so pesin go ansa sey, “No.” Naso he…