• Micah Chapter 7

    Sorrow Becos Of Israel Sin Israel Look Baba-God 7. But as for me, I dey watch inside di hope of Baba-God, I dey wait for Baba-God wey dey save me; my God go hear me. 8. No dey happy for my mata, oh badbelle pipo: wen I fall—I go rise; wen I sidon for inside darkness—Baba-God go be light for me. 9. I go endure as Baba-God dey vex, becos I don commit sin against am, but las-las he go defend me and he go correct di wrong tin wey don happun to us. He go carry me come out to see light; and I go see hin good-heart. 10.…

  • Nahum Chapter 1

               Baba-God Mercy Plus Judgement          Baba-God Vex For Hin Enemies 2. Baba-God na God wey dey jealous and wey dey revenge, Baba-God dey revenge and he dey vex well-well. Baba-God dey revenge on hin enemies; and he keep punishment for hin enemies. 3. Baba-God no dey quick vex, and he get pawa well-well; Baba-God no go free pipo wey do bad-bad-tins wit-out punishing dem. Hin way dey inside di rolling-breeze and strong-breeze, and cloud na di dust for hin leg. 4. He dey command di big-river, con make am dry kpatakpata, he dey make all di rivers dry. Bashan and Carmel dey fade, and di flowers of Lebanon dey fade.…