• Micah Chapter 5

    Ruler From Bethlehem Di Remaining Pipo Of Jacob 6. Dem go waste di land of Assyria wit sword, con enta di doormot of di land of Nimrod; naso he go take save us from di pipo of Assyria, wen dem enta awa land, con march enta awa borders. 7. Di remaining pipo of Jacob go dey among plenty pipo like dew from Baba-God, like rain on top of grass, wey no pesin fit hold am back, and no pesin fit stop am. 8. Di remaining pipo of Jacob go dey among di nations, for middle of plenty pipo, like lion among di animals for forest, like young lion among plenty…

  • Micah Chapter 6

    Baba-God Mata Against Israel Israel Punishment 9. Fear Baba-God if you get-sense! Hin voice dey call everi pesin for Jerusalem: “Di armies of scata-scata dey come; Baba-God dey send dem come. 10. Abi beta-beta-tins no still dey for wicked man house wey he gain wit wickedness, plus di wuru-wuru measurements—wey be curse? 11. Abi I go free man wey dey use mago-mago measurement, wey get bag of ojoro weight? 12. Her rich men dey shed blood; her pipo dey tok lie, and dia tongue dey yarn wit wuru-wuru for inside dia mouth. 13. So I don start to dey scata una till una taya, I go scata una kpatakpata becos…